Davido Defend Naija, Talk Say Everywhere Get Wahala, No Be Only Here
Written by YangaEditor1 on May 15, 2025
Davido Defend Naija, Talk Say Everywhere Get Wahala, No Be Only Here
Afrobeats star Davido don stand gidigba defend Naija against all the bad mouth wey people dey talk. E talk say wahala like violence and crime dey everywhere for this world, no be only Naija get am.
E blast media wey dey always carry Naija bad side put for front, but dem no dey show our better side or the levels wey we don reach.
For one interview wey e do, one French-speaking channel, Davido yarn say make people come Lagos with their own eye see how e be, instead of dey believe wetin dem hear.
E talk say:
“Everywhere get him own danger! Congo no safe, Benin no safe, even Paris sef no safe. Even for Atlanta, you fit waka enter one place wey dem go just shoot person – na so e be. The whole world no safe, na only God dey protect us.
You hear say e dangerous? Na why you suppose come see am yourself. You no fit dey hear hear. Na so dem dey do – dem go show the bad side, dem no go show the Bugatti dem. Dem no dey show the Ferrari, Rolls Royce or the private jet dem.”
E still talk say Naija get e own problem, but we no dey alone – other countries get their own wahala too.