Yanga FM 89.9

Owanbe

Our African Sound

Our African Sound

Our African Sound


Info and episodes

“Dapper Collect Dollar, Pay Naira!”- Tegaboi

Written by on May 18, 2026

Tegaboi DC : “Dapper Music Take My Shine, Now Dem Say I Owe $55K 

Tegaboi DC don comot for silence and him mouth no dey carry last. The upcoming street artiste wey dey make waves underground enter Yanga FM Cruise Express yarn the kind kasala wey him encounter under Dapper Music record label  and e be like say the gist no go end well for that label side.

“I No Sabi Wetin I Dey Do” — DC Confess Am Himself

Tega boi  no come pretend. Him talk am plain plain say when him sign that Dapper Music deal, him been dey very green and hungry for am. No entertainment lawyer, no proper check of the contract nothing. Him just enter with two eyes wide open but zero wisdom.

“I was naive and desperate,” him yarn. And that desperation? E cost am heavy.

Dollar In, Naira Out omo  The Exchange Rate  na Yawa

Now here na where the gist pepper dem. According to DC, Dapper Music dey run one kind funny arrangement  dem dey give  artists naira but dem dey collect revenue for dollars. E no balance at all, at all. Him collect ₦3 million for wey be  the highest money wey him don ever see with him two eyes. E feel good that time. But that joy no last.

 Zero Video, Zero Promo  But Dem Say Him Owe $55,000?

Despite say DC dey drop music under the label, Dapper never shoot even one video for him songs. No promotion, no push, no nothing. The label just dey chop air. And now  the plot wey twist pass Nollywood be say  Dapper Music don turn around say Tegaboi DC owe dem $55,000. The guy dey look like say e wan faint. We sef dey look like that. From where to where exactly?

Tegaboi DC Dapper

Ann chiewei ,Tegaboi and Emcee RnB at Yanga fm

Even Him Chains Na Him Buy Am Himself

Emcee RnB  no gree let am breathe come ask whether even the jewelry wey DC dey rock na label money buy am. DC answer come back sharp sharp say every chain, every piece  him use him own pocket buy am. Dapper never invest one kobo for him appearance.

Him also reveal say him don record banging songs with the Uzama Brothers  tracks wey fit blow  but Dapper Music slow movement dey hold everything down like roadblock. No clearance, no release, artiste dey stagnate.

The Real Gist for Every Upcoming Artiste

The part wey scatter the internet scatter am proper when DC yarn say the same label behavior na wetin push Shallipopi to crash out for Dapper Music last year. E no be coincidence  e be pattern. Tegaboi DC story na serious lesson wrap inside pepper soup  e hot and e go enter your body. Before you sign any deal, get a lawyer. Read every line. Know wetin you dey enter.

Because Dapper Music don get question to answer, and the streets don dey wait.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Continue reading

Current track

Title

Artist