You no be just my manager, you be my shield: Davido Talk About Asa Asika
Written by YangaEditor1 on May 19, 2025
You no be just my manager, you be my shield: Davido Talk About Asa Asika
Award-winning musician Davido don write one emotional message give im longtime padi and manager, Asa Asika, as e marry him babe, Leona
As Davido dey reflect on their journey, e talk how dem two don waka through thick and thin, and how di bond wey dem get na strong one wey fire nor fit burn.
E praise Asa for him correct loyalty, hard work, and say di guy dey always stand gidigba for their dream.
Davido still talk say Asa new wife, Leona, don bring out soft side for the guy body — make am dey smile more, calm down, and just dey enjoy peace. E thank Leona say she love Asa wella, with pure heart.
“Asa, today break me… but na in the sweetest way,” na so Davido talk for the touching tribute.
“As I see you dey stand with Leona, peace for your eye, love for your chest — I no fit hold myself. No be just because of who you be now, but how you take become that man.
Nobody dash us anything. We hustle am. From fire, from belief, from bond wey never scatter.
We no dey find fame. We hold ground. Stay true to our journey, true to our people. We no sell out — we carry the culture even when e heavy.
Na why blessing never stop, because we no leave ourselves behind.
You no be just my manager. You be my shield. My sense. My brother for all the fight. When everywhere dark, light no dey — you still dey.
Even now wey world dey hail us — you still be that same real G wey I start with.
But Asa… since Leona enter your life, you don change. You don calm. You dey smile more. You be man wey get peace now.
And as I dey watch how she dey see the real you — no be just the hustle you, no be machine — but the real Asa… e heal something deep for my heart too.
Leona… thank you. For loving am the way we all dey pray make person love am.
You no just join journey — you become the reason. You bring am back to himself.
I swear, as long as I still dey breathe, I go protect wetin you and Asa don build.
This wedding no be just about love. Na legacy.
Proof say we fit rise without lose who we be.
Say brotherhood fit still dey strong even after success.
Say we fit hold our culture — no be just for show.
Asa, we no just make am — we make am our own way. And as I stand beside you today, e dey give me wetin no award fit give me.
I feel at home. Forever beside you.
— David.