Yanga FM 89.9

Presented by Suo, MC Advice

Yanga Sports

Yanga Sports

Yanga Sports by Presented by Suo, MC Advice


Info and episodes

No Be Only Hymns I Wan Sing – Seyi Shay Talk Why She Comot Church

Written by on May 21, 2025

No Be Only Hymns I Wan Sing – Seyi Shay Talk Why She Comot Church

Singer Seyi Shay don talk say she no dey go her former church again because dem too dey strict for worship music. According to her, the church only dey allow hymns and songs wey come directly from Bible, dem no gree make dem sing modern gospel music.

No Be Only Hymns I Wan Sing – Seyi Shay Talk Why She Comot Church

No Be Only Hymns I Wan Sing – Seyi Shay Talk Why She Comot Church

She yarn this one for her Instagram page, where she blast the leaders of the church say na one of the major reasons wey make she waka comot be that.

She even add say many of the old hymns wey people dey sing today na slave masters compose am, and dem force our ancestors to dey sing am while dem dey beat and torture dem.

She write:
“One leader like dat for my former church talk say, ‘we need to stop singing all these new age gospel songs in praise and worship and go back to singing hymns and only songs that are direct scripture…’
Guess wetin? I stop to dey go that church. PERIODT.

Because I no understand why person go dey feel blessed and happy to sing songs wey slave masters write, force people to sing am and pass am down while dem dey beat and torture our ancestors… e no make sense at all. Make una do una research! Ignorance no be holiness o!!!”

She later clear the air say:
“No be all hymns na slave masters write ooo! But many of dem na so e be. Sometimes, e better make you compose your own praise and worship songs/hymns (if you like, base am on scripture).”


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist