Social media go destroy plenty people – Rudeboy
Written by YangaEditor1 on May 29, 2025
Social media go destroy plenty people – Rudeboy
Singer Paul Okoye wey people sabi as Rudeboy don show serious worry about the way Nigerian youths dey use social media anyhow.
Di “Reason With Me” crooner talk say people wey dey use social media just dey do clout and chase trend dey play with fire.
E warn say this kind waka fit spoil many people life.
For him Instastory, Rudeboy write:
“Social media go destroy plenty people… you fit think say na cruise, clout or just to trend… but your eye go clear las las.”
For Naija, social media still dey operate like free land as no strong body don dey regulate am well.
Many people don dey shout make government regulate social media because of things like online bullying, fake news, hate speech and to just spoil person name for nothing.
One bill wey wan regulate social media don enter National Assembly before, but people react scatter-scatter. Na so the bill still dey one corner. Social media people sef no gree, dem drag the bill well-well.