Yanga FM 89.9

Owanbe

Our African Sound

Our African Sound

Our African Sound


Info and episodes

Rita Edochie Don Change am for Haters Wey Wan May Drop Edochie Name

Written by on July 10, 2025

Rita Edochie Don Change am for Haters Wey Wan May Drop Edochie Name

Nollywood actress and Edochie family member, Rita Edochie, don cause kasala online as she stand gidigba support May Edochie wey be former wife of the ogbonge actor Yul Edochie.

Rita Edochie Don Change am for Haters Wey Wan May Drop Edochie Name

Rita Edochie Don Change am for Haters Wey Wan May Drop Edochie Name

For one long Instagram post na im Rita blast people wey dey talk say May suppose drop the Edochie name since she and Yul no dey again.

She no waste time insult the trolls, even as she pour plenty sweet words on top May head.

She talk say:
“Ndiala ndiala full ground. Her name still be Queen May Yul Edochie even after divorce, because no be una give her the name. If e dey pain you, madam shift or go hug transformer.
Make una rest well o, because that name don set like cement. Wetin person do una wey no even sabi say una dey exist? Owelu onye melu ibeya bikonu?”

Rita come advise the online haters make dem focus on their own life and stop to carry unnecessary vex for person wey no offend dem.

She yarn:
“Pray make your own success come, and with God, your own light go shine when e reach your time. Be happy for people wey God don bless, so your own go reach you too.

No dey carry anger wey no get head. No rush life or compare your journey with another person own. Just like sun and moon, everybody get their own time to shine. Society fit dey pressure you, but remember say God get better plan for you. Calm down and trust Him.

If you try force yourself, you fit burn out or even wound. Just dey go small small, dey celebrate your small wins, learn from any setback, and no stop to dey move forward.”

Na wetin people dey yarn about the matter be dis:

@bensonokonkwo_official_: “Na true talk, mama wey sabi. I dey always call her Daughter of Grace, she go continue to dey shine, nothing fit stop am.”

@royal_kiddies_1234: “As long as she get pikin wey bear that name, she go bear am reach forever.”

@onyekachi142: “Even Anita Okoye still dey bear her husband name. Abeg make una free my Queen May, I love her die.”

@sa.ndra7452: “Na Judy dey cause all this wahala. That one dey jealous anyhow.”

@itz_realsuccessofficial: “If no be for Queen May, nobody for dey hear Yul name again. Na May still dey make us remember say person like Yul dey exist.”


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist