Menu
Qing Madi’s New Banger With Lil Wayne!
Written by YangaEditor1 on October 27, 2025
Qing Madi Don Announce New Jam With Lil Wayne & Keith Sweat
Qing Madi Don Drop Big Gist
Na hot gist wey land for internet be this!Afro beat fast-rising singer Qing Madi don finally announce say she get new single wey go drop soon, and e no be ordinary collabo o she dey feature Lil Wayne and Keith Sweat.
Fast-fast the announcement come shortly after she do one lively Instagram live session with Shank Comics, where she just dey gist and vibe with fans. As na for middle of the laughter and cruise she drop the bombshell wey scatter everywhere!
Fans Don Go Wild
As she make the announcement, fans no gree calm down. Social media don full with reactions and some people dey shout say the combo too mad, others dey ask how she take connect with two legends like Lil Wayne and Keith Sweat.
She even talk say, “This one no be small something. I dey come with full fire!” and from her confidence, everybody believe say the track go shake the industry.
From Naija to the World
Qing Madi don already prove herself as one of the brightest young voices from Naija, with her sweet blend of Afro-soul and R&B. Now with this kind international collabo, e clear say she no dey play at all.
Them no waste time her team don drop official release date as Friday , she hint say make fans ready because the song go soon land sharp sharp and e go “change the sound.”
Wetin to Expect
As the live enter naso she play the the small snippet , the beat get that cool mix of Naija Afro vibe, old-school R&B, and Lil Wayne’s rap touch something different but still catchy.
Qing Madi talk am clear: “Na global sound I dey chase. Make una ready, I wan blow everywhere!”
Final Gist
As we dey wait for this hot jam to drop, one thing sure Qing Madi dey rise fast, and she no dey plan to slow down. If she fit pull off this collabo, e go solidify her name among the next generation of African stars wey dey take over the world stage.
Na fire we dey expect, and we ready!
