Menu
Compound Wahala
Compound Wahala
Compound Wahala by Presented by Rugged Pastor & BabyLawyer
Info and episodes
Popular media personality Toke Makinwa don cause serious buzz for Lagos as she dedicate her baby . Star Baby Yakira, was dedicated inside one classy, star-studded ceremony wey get everybody talking. From the luxurious hall décor to the A-list guest list, Toke really show say she sabi how to do things in style.
The event take place for one top-notch venue for Lagos, and the decoration alone fit make person open mouth. Everywhere shine bright colors , fresh flowers, soft lights omo the whole thing be like fairytale. People talk say the ceremony look like something wey fit trend for weeks.
Toke no fall hand at all as she appear in one elegant, designer outfit wey match her confidence and grace. She radiate joy all through the event as she carry her baby proudly go church for the dedication.
The ceremony no small at all as A-list celebrities come full ground to support her. From Funke Akindele to Tiwa Savage, Toyin Abraham, and other socialites, the place full with stars wey no dey ever dull moment.
Everybody dress to kill, and the atmosphere sweet like party. People wey attend share plenty fine pictures and videos online, hailing Toke for organizing one of the most elegant baby dedications in recent memory.
Toke Makinwa later thank everyone wey show love and support. She talk say the day be one of the most special moments of her life and that Baby Yakira don bring her new joy and purpose. Based on say she been dey inside social media drama as she born this pikin ,infact many people even no happy as she born without husband but she talk say she don settle things with God and this na new chapter for her life and he pikin life .
Even as the event end, many fans and celebs still dey talk about how beautiful everything be. From the decoration to the fashion, food, and great vibe. Truly Toke really outdo herself.
The glamour queen don once again prove say she no just get style as she get grace, class, and heart.