Yanga FM 89.9

Compound Wahala

Compound Wahala

Compound Wahala by Presented by Rugged Pastor & BabyLawyer


Info and episodes

Grammy 2026: Nigeria’s Big 5 Ready

Written by on January 28, 2026

2026 Grammy Predictions: 5 Nigerian Stars Set to Battle for Gold This Sunday!

By: Ezurumem Obinna

This Sunday, February 1, 2026, the Crypto.com Arena go turn into battleground as five of Nigeria’s biggest musical exports fight for Grammy glory. And trust me, the vibes go dey electric!

Who Dey Fight for the Crown?

Make we break am down sharp sharp. The Nigerian squad wey dey ready to collect their flowers includes:

  • Burna Boy
  • Davido
  • Wizkid
  • Ayra Starr
  • Omah Lay

Five nominations across two categories!  when last we see this kind lineup? Nigeria don show say we no come to play.

Grammy 2026 Nigerian artists

Grammy 2026 Nigerian artists

How We Take Reach Here?

You remember when Afrobeats been dey struggle to get international recognition? Those days don pass! The genre’s massive success for America streams wey dey run into billions, sold-out tours, and collaborations with top American artists na wetin push the Grammys to finally create the Best African Music Performance category.

 Our very own Tems break the ice last year, becoming the first Nigerian to bag the award at the 2025 Grammys. The babe set precedent! Now, the question be say  Who go follow her footsteps?

The Competition Dey Hot!

While our Nigerian stars dey prepare their acceptance speeches (we dey claim am in advance!), them no dey alone for the race. The competition includes:

  • Tyla from South Africa (the “Water” girl wey don dey make waves!)
  • Eddy Kenzo & Mehran Matin from Uganda (East Africa say make dem no count them out!)

E be like African music Olympics! Different countries, unique  vibes, but one goal na to bring the Grammy home.

TikTok creators don start dey make Grammy content.

Sunday Don Almost Reach

As we dey count down to Sunday, February 1st, one thing clear be say, Nigerian music don write its name for gold for global stage. Whether we collect one Grammy, two, or even all the categories we dey contest for, we don already win by being nominated.

The 68th Grammy Awards go be special, and trust Nigerians to turn up for their own. Expect social media to scatter.  watch parties everywhere and  the whole country on a chokehold .


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist