The Omotola Jalade Rebellion Wey Pay Off Well Well
Written by YangaEditor1 on February 4, 2026
Omotola Jalade: How Federal Government Ban Turn me to cash madam
Nollywood royalty Omotola Jalade-Ekeinde just drop heavy gist for Yanga FM, and walahi? The matter hot pass pepper soup wey dey boil for cold Lagos night. Remember when you no see am on screen for some time she don yarn wetin really happen and e go shock you !
The great Nollywood black out
The veteran actor open up say Eight of Naija most correct screen stars including Omotola herself, Stella Damasus, Genevieve Nnaji, Nkem Owoh, and Jim iyke suddenly been dey banned from the thing wey dem sabi do pass. Federal government yarn say the These b people na “bad influence” for general public.
While most of her colleagues rush go meeting after one year, dey beg make dem collect their acting license back, OmoSexy do different thing. She sidon for house. “I get strong head,” she talk say, as she call the whole thing “injustice.”
From Red Carpet Straight to Real Estate Mogul
But see where matter sweeter pass. Instead make she dey cry, Omotola carry her businesswoman sense come outside. Those lands wey she don buy keep for corner? Na time to develop am. Sharp sharp, she enter real estate business while camera dey off.
“That ban sef give me more money,” she yarn, as everybody mouth open. While her colleagues dey run up and down for clearance, mama dey build empire, dey rest well, dey focus for family. Sometimes na when life block your road, e dey show you where your destiny dey and OmoSexy own carry am straight go bank.
The Bigger Picture
The ban finally lift after two long years, but by that time, Omotola don already win finish. Her absence from Nollywood no be say she tire or she wan retire na government wahala wey turn golden opportunity.
Sometimes when you stand your ground, e fit cost you small time but e go pay you back later. Omotola still come back the game hot as ever and still dey give us back to back .
