Yanga FM 89.9

yanga drive

Cruise Express

Cruise Express

Cruise Express


Info and episodes

The Real Gist: Omotola & Genevieve kasala

Written by on February 4, 2026

The real Thing wey cause Omotola and Genevieve kasala !

Omotola Jalade just scatter one of Nollywood’s longest-running “rivalries . She don open upfor her recent sit-down with Yanga FM, and the truth go shock you small.

The Beef Wey Never Exist

 For years, blogs and gossip mills don chew this supposed bad blood between OmoSexy and Genevieve Nnaji like say na breakfast. But according to Omotola herself, the whole thing na pure fabrication.

The Yanga FM host(Jaycee talks)  no come play when he ask am point blank “Na that ‘Ije’ film scratch una 20 years beef?” The way he phrase am sef, you go think say the two queens been dey box for red carpet.

“This Country Like Agenda Die”

Omotola no send anybody as she break am down proper. “Over time, this country too dey like agenda,” she yarn with the kind of clarity wey go make you pause your Instagram scrolling. She compare am to wetin dey happen for Afrobeats industry. She claim say na how people dey always put artistes against each other like say na wrestling match.

Omotola jalade Ekehinde

Omotola jalade Ekehinde

“No single beef dey,” she talk am clear clear, like person wey don tire for the narrative. “Them dey talk well well say no single beef. We dey the same career.” Just like that, she don cancel years of speculation, fan wars, and WhatsApp group arguments.

Film wey no get end

Truth be say, Nigerians and honestly, people everywhere love good rivalry story. E be like soap opera wey no fit end. But sometimes, the real story boring pass , two successful women just dey mind their business, dey shine for their own corner.

The 2010 film “Ije” wey feature both queens as sisters supposed don settle this matter since, but you know how e be. People prefer the spicy version of the story pass the plain truth.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist