Omotola -I No Fit Dance for TikTok sell my film
Written by YangaEditor1 on February 4, 2026
“I No Fit Dance Anyhow for TikTok to Sell My Film”-Omotola Jalade
Social media don change the movie game finish, but Omotola Jalade-Ekeinde just tell us where she go stop. And honestly? The woman valid like mad . At some point e get where you go draw the line based on your power.
New Age Marketing Wahala
For her recent interview, OmoSexy drop one bombshell wey go make some people nod their head well well. “Marketing don change since social media enter the business,” she talk am straight. No lies detected there Cause these days, if you no dey TikTok, you no dey exist.
Omotola no dey knock anybody hustle. “I no dey look the people wey dey dance one kind oh,” she yarn with the kind of respect wey show say mama understand say everybody get their own lane. But when e come to her own matter? Different ball game entirely.
The Respect Wey Dey Sweet
With the confidence of someone wey don already make her name, Omotola declare say she no fit dance anyhow just to promote film. E be like say she draw invisible line for sand talk say, “This one, I no dey cross am.”
Wetin make this gist special no be say she dey judge other people na say she know herself well well. Some people fit breakdance for red carpet, do challenge with their leg for air, dey whine waist for Instagram live. Omotola? She dey her own lane, dey cruise steady.
Excellence Without the Extra
The fact say she no go dance no mean say she go slack for her career. “I go continue dey excel for movie industry,” she yarn with the kind of assurance wey no need backup dancers.
Omotola don show us say you fit stay relevant without losing yourself. You fit move with the times without compromising wetin make you, you. Some people go dance, some go just act well and comot.
