Yanga FM 89.9

yanga drive

Cruise Express

Cruise Express

Cruise Express


Info and episodes

“Portable’s Juju? Praiz Finally Explain Am”

Written by on February 27, 2026

Disrespect Choke for industry and Portable No dey gree  -Praiz

Our very own R&B original, Praiz, recently settle down with Yanga FM and e be like say him carry bucket full of truth come. No fake smile, no industry packaging  just raw, correct gist about something wey every artist dey quietly battle wey be Respect.

The Industry Go Look You Well Well And  That One Na Fact

Praiz no waste time dey do up and down. Him land the thing straight .Nigerian music industry get one simple but brutal energy. People go scan you, calculate your value, and treat you according to wetin dem think you worth.

Him say the real wahala no be the industry itself. Na you. According to Praiz, the industry only fit finish you if you gree make dem finish you. You must first decide your own worth before another person come decide am for you. Sharp.

Praiz explain How Portable stays relevant in Nigerian music

So Why Him Dey Hail Portable? E Get Why O

This na where the interview begin dey pepper body small. Praiz openly confess say him genuinely like Portable  and e no just be about the music. Him dey respect the energy.

Before you begin side-eye the matter, hear am well. Praiz talk say Portable’s relevance no be luck or jazz. The Zazu master no just dey make noise ,him dey resist disrespect every single time. Loudly. Dramatically. Sometimes e dey scatter everywhere. But him never stop. And that consistency Na the real juju.

For industry wey dey sort people into “relevant” and “don go” folder every day, Portable simply refuse to enter that folder. Him show up, him stand him ground, and both the culture and the algorithm keep dashing him attention because of am.

The Real Lesson Wey Praiz Dey Teach

Remove all the glam and the gossip, Praiz dey basically tell us say  self-respect na career strategy.

Artist wey dey swallow disrespect quietly tend to quietly disappear too. But the ones wey draw their line   even if e scatter small, even if e dey loud  those ones dey always find a way to stay.

No forget to tune into yanga 89.9 make you dey hear better informate !

Tagged as

Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist