Yanga FM 89.9

Presented by Suo, MC Advice

Yanga Sports

Yanga Sports

Yanga Sports by Presented by Suo, MC Advice


Info and episodes

Sarah Martins Dispatch Drama to Donation Wahala

Written by on March 3, 2026

Sarah martins Order Package. He Deliver Love. Internet Deliver Chaos.

    Our own Sarah Martins actress, influencer, philanthropist wey get heart of gold been  no know say one simple online order go turn her life upside down like akara wey fall for ground. But e happen, and e sweet pass Telemundo.

So she order something online. Dispatch rider bring am. Drop the thing. Normal na. But wait  this same rider, after e deliver the goods, come decide say e wan deliver him heart too. Right there. On the spot. E come dey profess love like say na set film dem dey shoot.

Sarah vex well well naso She report am give the brand owner sharp sharp. Everybody think say matter don end there.

This na Nigeria so story no dey end like that.

Something touch madam heart. She come rethink the whole matter. Not only that  she invite the guy commot! The same actress wey dey always do good go her fans, begin solicit funds for the man. “Help am buy bike,” she talk. “Make him business flourish.” And fans wey love her gather funds like say na church offering.

Meanwhile, Sarah go Yanga FM come open mouth reveal say she genuinely think the guy dey single. She no know say the man get wife  proper, legal, full-package wife dey house wait for am.

Bybisasa ,Sarah Martins and Jayceetalks

Bybisasa ,Sarah Martins and Jayceetalks

E still never finish and e even sweet reach here.

The day Sarah invite am commot, she no know say the man get company for roster. Worse pass that  the guy lie for him workplace say e dey go church convention. Church. Convention. While e dey waka go hangout with celebrity wey just raise funds for am online. The liver wey this man carry, e heavy like truck.

When the video land and people begin connect the dots . Married man, fake church story, public fundraiser  the drag begin. Nigerians pour am from all angles, say Sarah just dey do rubbish, say she no suppose dey involve herself with somebody else husband.

 No be the first time Sarah scatter internet 

The woman don go viral before when dem arrest am as she dey cook for road. The whole thing cause serious ruckus for that area. Na so everybody come know say Sarah Martins na full-time headline generator. The koko be say she don clear the air and no wey everybody go know say she no get minf follow person man .

you fit still listen to us for better gist and hot informate !


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist