Menu
Compound Wahala
Compound Wahala
Compound Wahala by Presented by Rugged Pastor & BabyLawyer
Info and episodes
BY :EZURUMEM OBINNA
Alexx Ekubo, the Nollywood oga wey everybody love, don kpai on Tuesday, May 12, 2026, after e fight kidney cancer for long time. The man was just 40 years e just celebrate im birthday on April 10, barely one month before dem carry am go. Filmmaker Sam Olatunji carry the bad news go Facebook, and before morning reach, timelines don full of tributes like Lagos flood wey nobody plan for.
If you watch The Bling Lagosians or Afamefuna and you no feel anything abeg go check yourself. Ekubo dey carry every scene with the kind of swagger wey look like im no even try. But e no be magic na years of hustle and grind wey nobody see give am that grace. E no just be the fine face for poster. The baba fit act, full stop.
Industry people know am. Fans know am. United Nations even put im name for their 2020 list of Most Influential People of African Descent Under 40. E also be 2010 Mr. Nigeria first runner-up. The man get range for screen and outside am.
Im last post for Instagram na December 30, 2024. After that nothing. No reels, no stories, no “oga I dey” update. Fans begin dey ask question. Some people think say e just wan rest from the wahala of toxic internet. Others dey refresh im page up and down, dey hope say im go appear.
But wetin everybody no know be say the man dey fight for im life quietly. Social media, with all the insult and unsolicited opinion wey people dey give, no be place for person wey dey battle serious sickness. So e log off. Honestly who go blame am?
On Monday, May 11, dem rush Ekubo go hospital for Lagos. E spend hours on life support before e give up the ghost Tuesday afternoon. Im family don release official statement as at the time of this report.
Funke Akindele talk say she try reach am to see am one last time e no work out. Kate Henshaw and other colleagues also drop tribute online. The pain for internet that day? E was real and e was plenty.
Forty years. Films wey go dey relevant forever. A personality wey make am give chop knuckles to everybody doorman, desk person, industry big man nobody dey left out.
Na that kind person Nollywood lose. Not just actor. A full, warm, gbas gbos human being wey love everybody well well.
Continue dey listen to us for better gist