Yanga FM 89.9

Young Shall Grow

Young Shall Grow

Young Shall Grow


Info and episodes

Falz Say E No Get Any Relationship Wit Bobrisky, E Just Wan Help

Written by on June 5, 2025

Falz Say E No Get Any Relationship Wit Bobrisky, E Just Wan Help

Popular Naija musician, Folarin Falana wey people sabi as Falz, don deny say e get any kain relationship wit the popular man wey dey dress like woman wey im name be Bobrisky.

Falz Say E No Get Any Relationship Wit Bobrisky, E Just Wan Help

Falz Say E No Get Any Relationship Wit Bobrisky, E Just Wan Help

This one dey happen as VDM, wey dey face court wahala now, still dey drag matter for social media.

Report bin talk say VeryDarkMan (wey dem dey call VDM), last year leak one phone call wey dem claim say happen between Falz and Bobrisky when Bobrisky still dey inside prison.

Because of that, Falz carry matter go court, accuse VDM say him spoil him name (defamation).

The matter make plenty people begin carry rumour say Falz fit dey into homo things.

But as Falz yarn for interview with Arise TV on Wednesday evening, him talk say the case still dey court and VDM never even bring him own defense.

As dem ask am about Bobrisky, Falz talk say him no get any personal relationship with am, say na just help he bin wan help.

“Update about the court case be say, the matter still dey ground. Me and my papa carry case go court say person spoil our name. Since we file am, dem never bring any defense come. Instead, dem just dey talk say court no get power to judge the matter.

“The last time we go court, the judge throw away that talk. Now dem gats bring their defense or court go just give judgment. That na the update. I no go fit talk too much because the matter still dey court, so make I just stop there.

“I no get any relationship with Bobrisky before that phone call. Na him message me for Instagram say, ‘I dey inside one wahala and I wan talk to you about how you fit help.’ And as usual, I dey always get that kind message from plenty people.

“This one no be special case. I just reason say make I hear wetin him wan talk. Na normal thing, out of human compassion. I no know say e go turn like this. But as dem dey talk, once dem bite you, next time you go shine your eye.

“Maybe I no go help anybody again, or maybe I go just dey more careful,” na wetin Falz talk be that.

Make una watch the video here:https://www.instagram.com/reel/DKfUYxrNI7Y/?utm_source=ig_web_copy_link


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist