DTigress Break All Records! 5-Time AfroBasket Champions
Written by YangaEditor1 on August 4, 2025
Na celebration full ground as Nigeria women basketball team, DTigress, don carry AfroBasket Women’s Championship for the 5th time in a row! Yes, you hear am well na FIVE times back-to-back! omo na history dem don write again as dem finish Mali 74-61 for the final wey happen for Kigali, Rwanda.
DTigress No Dey Carry Last
From tip-off to final buzzer, DTigress no gree breathe Mali at all. Dem carry fire enter court like say dem wan collect their birthright. furthermore As the match dey go, Naija girls just dey throw correct 3-pointers, block shots, and run fast breaks wey scatter Mali defense. Before Mali fit ask “wetin dey happen?”, DTigress don dey lead dem wella.
MVP Na Our Own Amy Okonkwo
Amy Okonkwo wey shine pass torchlight for the whole tournament. Naso She burst net, defend strong, and even dey assist her teammates like true baller. Because of that, dem crown her Most Valuable Player (MVP). No be beans o – she really carry the team for her shoulder like wrapper!
Coach Rena Wakama Na Real Game Changer
Make we clap for Coach Rena Wakama, the first female coach to win AfroBasket with Nigeria. She bring sense, discipline, and serious ginger enter this team. Since she enter, DTigress never look back. Under her control, dem just dey win steady. E come be like say her coaching na winning charm.
Nigeria Don Rule African Basketball
With this latest win, DTigress don officially turn the queens of African basketball. No other team fit boast this kain record. And the whole Africa dey feel the heat. Social media don catch fire with hashtags like:
-
#DTigress
-
#AfroBasket2025
-
#NaijaNoDeyCarryLast
-
#WomenInSports
-
#DTigressVsMali
Wetin Next for DTigress?
This win no be just for bragging rights. E also mean say DTigress don qualify for Olympics qualifiers and FIBA Women’s World Cup. So no relax o more action dey come. And if DTigress continue like this, na world domination sure pass.
Make We Celebrate Our Champions
DTigress don show say Nigerian women no dey dull. Dem strong, smart, and sabi represent the green white green with pride. As dem dey dance legwork for Kigali, make we for house join dem celebrate. This na win for all of us.
Abeg Share This Gist Sharp-Sharp!
Na stories like this dey inspire. Make e reach every corner say DTigress don do am again also From Ajegunle to Aba, from Jos to Jalingo, Naso Naija dey rise and our women dey lead the way!