Yanga FM 89.9

yanga drive

Cruise Express

Cruise Express

Cruise Express


Info and episodes

Streams no matter Na Tickets be koko -EFE

Written by on February 20, 2026

Wetin Efe yarn about Real Success as an artiste for Naija

by :Ezurumem Obinna

If you think say Grammy nomination and millions of streams na the only way to measure success for music, Think again . Efe just waka enter Yanga FM and scatter your whole theory to the ground. The former Big Brother Naija winner wey don become proper recording artist sit down, open him mouth, and drop the kind of gist wey go make you stop and think well well.

300 Tickets Or E Never Happen

Efe no come with grammar. He come with unfiltered, and  industry-shaking sense. According to the Urhobo king himself, true success as artist na simple thing. The day wey you drop tickets for your own show and at least 300 people willingly comot their money, buy those tickets, and show up , na that day you don arrive. No free entry. No guest list arrangement. Just real fans paying real money to come see you.

That definition hit harder than any industry award. Because anybody fit stream your song for free, but buying ticket? Na commitment that one be. Na love and your fans dey tell you say “we believe in you sotery e reach  to pay.”

Efe for Yanga  fm

Ann Chiewie ,Efe and Emcee Rnb  for Yanga fm

The Man, The Myth, The Urhobo Warrior

Now na here Efe take things reach another level entirely. The Delta State son make am clear as glass say him be Urhobo identity no dey for negotiation, e no be decoration, and e no dey go anywhere. He yarn with full chest say he go keep infusing Urhobo language and culture inside him music for as long as he dey breathe and if Jesus never come, even longer. Till Jesus come, as him talk am himself. No sorry, no code-switching to please industry people, just pure Urhobo energy wey he don season inside every track wey he drop.

E dey give cultural pride, dey give authenticity Plus absolute zero concern for anybody wey no fit keep up.

 This Interview Matter Pass You Think

The industry get  plenty artists dey chase clout, algorithm tricks, and industry validation, Efe come out here dey measure success with completely different ruler and e fresh like cold zobo on a hot afternoon. Him definition put the fan for center of everything. The real human being wey love your music enough to show up.

That one na sustainable artistry.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist