Yanga FM 89.9

Tiwa Savage Yarn Say Naija Men Get Swag But No Sabi Romance

Written by on May 2, 2025

Tiwa Savage Yarn Say Naija Men Get Swag But No Sabi Romance

Afrobeats star, Tiwa Savage, don talk say most Naija men no too sabi romance, even though dem dey always dress fine and get correct swag.

Tiwa Savage Yarn Say Naija Men Get Swag But No Sabi Romance

Tiwa Savage Yarn Say Naija Men Get Swag But No Sabi Romance

As she dey yarn for one interview with GRM Daily’s “Thoughts in a Culli”, Tiwa describe Nigerian men as “swaggalicious but not romantic.” She talk say dem sabi show off money and style well-well, but when e reach to show real love and affection, many of dem no dey try.

The mother of one talk say plenty of these men dey more interested in showing off material things, instead of trying to build better emotional connection.

She come add say for her own side, romance no be about money and flashy lifestyle. Wetin she dey find na person wey get true feelings and sincerity inside relationship.

“Naija men get swag no doubt, but when e reach romance, dem no really dey deliver.
Dem sabi do swag and splash money, but na no be wetin I dey find,” she yarn.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist