Yanga FM 89.9

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija


Info and episodes

Davido Yarn Say Im twin pikin resemble Im late Son Ifeanyi

Written by on May 5, 2025

Davido Yarn Say Im twin pikin resemble Im late Son Ifeanyi

Popular Nigerian musician, Davido, don yarn say him twin pikin resemble him late son, Ifeanyi, no be small.

Davido Talk Say Him Twin Son Be Like Na Ifeanyi Come Back to Life

Davido Talk Say Him Twin Son Be Like Na Ifeanyi Come Back to Life

Davido open mouth talk this one when him go do interview with Ebro Darden for Apple Music 1, where e talk say the way the small boy take resemble Ifeanyi dey fear person — say the likeness too strong, e even dey somehow.

Everybody sabi say Ifeanyi na Davido first son with Chioma, wey sadly kpai on October 31, 2022, after e drown for Davido swimming pool for Lagos, just when e be only 3 years.

But for October 2023, Davido and Chioma welcome twins — one boy and one girl — for America.

As Davido dey talk about the pain wey Ifeanyi death cause, he yarn:

“That kain loss just break me. I tell myself say, ‘I no dey do again. I just wan calm down, take care of my wife and family, make my head for correct.’”

“But to still bounce back from that kain thing, and God come give us twins, e just show say God really dey. And the boy? Omo, e resemble Ifeanyi like say na the same person. The thing dey fear person. Na like say na Ifeanyi come back. All of us dey look am dey talk say, ‘Omo no be joke — na Ifeanyi be this o. E don show again.’”


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist