Papaya Ex Spill: “Bobrisky wey be Father”
Written by YangaEditor1 on December 17, 2025
Papaya Ex Spill Tea: “Bobrisky Na person Papa, him Just Dey Play”
By; Ezurumem obinna praise
The social media sensation and actress Papaya Ex don finally clear the air on her recent social media buzz. In a candid interview, she talk openly about her relationship dynamics, rumors, and how she dey handle haters.
Bobrisky Na “Father and him dey play with himself “
Papaya Ex yarn say Bobrisky go be person father soon him just dey play , and everything wey dey between them na actual fight matter and she just no dey pay attention to am . She make am clear say she no regret the way she take answer bobrisky with the whole beef wey happen and she like as she troll am back.
She even talk say Bobrisky go soon give person bele and he go soon know. The actor stress say him dey play with himself not her . Her words show say she no dey take the situation lightly and she no really rate am like that.
“I No Sabi Who Be Tosin Silverdam”
In her words put rumors to rest by confirming she no sabi Tosin Silverdam. In her words emphasize say she dey focused on her own life and career rather than chasing other people matter. For the interview jaycee talks ask am about how she see silverdam she answer say she no even send am and him go talk dey go she no dey see and pay attention to am.
No Time for Haters and Bad Energy
She make am clear say she no dey pay attention to haters. Papaya Ex say she no get time for negative vibes and prefer to dey channel her energy into positive things. She even talk say she dey mute and she dey block anything wey stress am likewise the people around her them dey always shield am from all that bad energy and noise.
Work Dey Show
According to her, all the grind dey pay off. She say as she dey focus on her career and projects, results dey visible. Her progress show say ignoring drama and focusing on work fit really make a difference.
Papaya Ex story remind fans say staying focused, avoiding negativity, and having fun na the key to growth both personally and professionally.
