Secrets of Baba Segi Wives Turn Savage Film
Written by YangaEditor1 on January 19, 2026
Secrets of Baba segi wives novel to movie ?
Some stories no dey ever die ,Dem dey grow leg comot from book enter stage, later jump reach cinema. Na so Lola Shoneyin powerful novel The Secret Lives of Baba Segi’s Wives don begin new life again. EbonyLife dey adapt Lola Shoneyin novel Secret Lives of Baba Segi’s Wives to 2026 film; cast, plot, and power drama set to shake Nigeria cinema. Di book wey first land for 2010 don enjoy many journeys and translation, theatre show for London, classroom debate and now e don return as book reimagined for big screen.
Plan Don Change, Fire Still Remain
Director Daniel Oriahi dey pilot di matter, and e get reputation for handling deep psychological drama. Screenwriter Adze Ugah dey transform di layered novel to visual experience without removing di original pepper. EbonyLife join body with Genesis Group, Nile Media, and Silverbird so distribution go reach Naija, UK, and other western territories.
Dis production no small at all. Di line-up include Odunlade Adekola, Iyabo Ojo, Mercy Aigbe, Bimbo Ademoye, Omowunmi Dada, Shaffy Bello, Lateef Adedimeji, Kunle Remi, Bisola Aiyeola, Kiekie, plus many strong names. With dis kind squad, audience don already mark calendar for December 2026.
Story Wey Pass Polygamy
Many mind go first think say na ordinary polygamy tale. But true matter be say di novel talk more about power, pride, and lie wey men fit build around masculinity. Baba Segi be wealthy man for Ibadan, no sabi book, yet e hang him respect on one thing wey be him ability to born children.
For years, Iya Segi, Iya Femi, and Iya Tope manage di compound with coded peace. Then Bolanle arrive ,educated, calm, and childless. Her presence start to shake di foundation. She ask questions, she trust hospital, and hospital begin expose truth wey some people no wan hear.
Film wey Go Loud
Dis 2026 adaptation fit become cultural moment for both Nigerian and western audience. Di mix of tradition, woman voice, and hidden secrets go hook viewers from Lagos reach London. As di book don dey reimagined for screen, everybody dey wait to see which lie go break and which character go survive when light finally shine.
