Yanga FM 89.9

yanga drive

Cruise Express

Cruise Express

Cruise Express


Info and episodes

Wizkid vs Seun Kuti: X Don Turn War Zone

Written by on January 21, 2026

 Seun Kuti enter hot gbas gbos as he drag Wizkid FC naso wizkid reply am  

Music heavyweight  Wizkid don take over world trend again, and this time e no be song or show. The Starboy enter X (formerly Twitter) with fire, and e ignite old beef between am, Seun Kuti, and Wizkid FC. As expected, timeline scatter. No be small gbas gbos.

How Seun Kuti Open Old Wound

Hot gbas gbos start when Seun Kuti, wey be Fela Kuti pikin, drop hot post wey target Wizkid FC. Na so the man yarn say:

“E nor go beta for all the Wizkid FC. Fela get Guinness World Record as one of the most recorded artists. Fela drop 52 albums. From 1960 to 1997, na him era, 37 years straight, no fall off.”

That post land like match inside fuel. Wizkid FC vex sharp sharp, talk say Seun dey downplay Wizkid success.

Wizkid FC Carry Am Personal

Once Wizkid FC enter, peace waka comot. Fans begin drop receipt O2 Arena sell out, world charts, international awards. Meme full everywhere. Before you know, Wizkid name don trend for many countries. The matter long nor be small and trust Fc to pour fuel inside ragging fire with their crazy takes  and comebacks on top the matter omo dem drag  seun kuti  like i pass my neighbor gen.

Wizkid Seun Kuti clash

Wizkid Seun Kuti clash 

Wizkid Return With Fire

This time, Wizkid no keep quiet. Baba drop better drag for X. One post shake internet:

“Fela fight for freedom this fool dey fight FC! Oloshi omo ale!”

Fans shout “Starboy no dey dull,” while some people say e too harsh. Either way, everywhere burst.

As wahala dey grow, DJ Tunez, Wizkid long-time guy, add him own talk. From there, everybody turn music professor and culture analyst by force.

This Beef No Be Today

This fight no start today. E go back reach 2021 when Wizkid win Grammy for Brown Skin Girl with Beyoncé. Seun Kuti talk say na Beyoncé carry the award, not Wizkid. That talk pain Wizkid FC well well.

Since then, na old school versus new school matter. Seun dey defend Fela legacy, activism, and cultural fight. Wizkid FC dey push global success and numbers.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Continue reading

Current track

Title

Artist