Yanga FM 89.9

yanga drive

Cruise Express

Cruise Express

Cruise Express


Info and episodes

Betrayer? TML Vibez alleged Rift with seyi vibez  

Written by on January 28, 2026

Betrayer? TML Vibez alleged Rift with seyi vibez 

By; Ezurumem Obinna

TML Vibez, the young talent wey don dey make waves for the street, sit down for Yanga FM studio come decide say enough is enough. E don tire to dey hear different versions of him story wey no even sound like wetin really happen. The rising star finally open him mouth  clear all the rumors wey don dey fly up and down about how he take blow for the industry. And omo, the matter sweet well well!

Breaking Down the Betrayer Allegations

Now, make we rewind small. If you don dey follow Nigerian music gist, you go remember say Seyi Vibez been call TML Vibez “betrayer” sometime back. The matter been hot like asun wey fresh comot from fire. Everybody been dey wonder wetin sup between the two talents. Social media don turn WWE arena many  people been dey take sides left, right, and center.

TML Vibez X yanga fam

TML Vibez X yanga fam

But TML Vibez, sharp guy wey him be, come address the matter during the interview. According to am, e no even understand where the “betrayer” cap come from. “Abeg, make una hear the full story first,” na so the vibe be.

Dapper: The Real MVP Behind TML Vibez Success Story

For the interview, TML Vibez make am crystal clear say na Dapper (music executive and talent manager) actually put am for the map. Not to discredit anybody o, but  make we give credit where credit dey due.

“Na Dapper discover me,” TML talk am straight, no chaser. E be like say the guy just wan set the record straight once and for all. Him explain say while plenty people dey quick to attach Seyi Vibez name to him breakthrough story and yes, there’s some connection there the full picture dey different from wetin people think.

The Grass to Grace Narrative Gets New Chapter

TML Vibez talk say if anybody wan tell him grass to grace story properly, Seyi Vibez name go definitely dey inside, but e go just be “small time” mention. However, e promise say soon him go drop the complete, unedited version of how him journey been really go.

Perhaps the most interesting part of this whole saga na the promise wey TML Vibez make. Him talk say when time reach, him go spill the complete tea about how him journey been really be.

Watch full video ;https://youtu.be/AVuxeE95K8w?si=07OGMNtsQcyT64H-


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist