“Celebrity Wey Everyone Know Molest Me” – Denrele Talks
Written by YangaEditor1 on January 30, 2026
Denrele Edun Opens Up on Industry Demons
Denrele Edun no just waka enter Nigerian entertainment industry o baba enter with full feather and gele. Come dey shine like person wey no send anybody papa. But as e be so, the guy wey always dey jolly just yarn wetin fit make your body dey shake. For interview with yanga fm him no hold mouth, our presido don open book well well. Omo, the gist heavy die!
“Everybody Dey Look Me Like Say I Don Craze Finish”
When Denrele first land for the scene with him correct eccentric drip people for industry no dey smile at all. Instead, dem just dey look am one kain like say na alien land from space.
“People no fit understand why I bold reach like that,” him yarn, as e dey remember those early days. Those days wey him fashion sense and him “I-no-send-anybody” vibes make am become the person wey everybody dey ask question about. While other people dey play am safe with their boring suit and regular behaviour, Denrele dey busy dey change the whole game for Nigerian media.
The Kpakpando Gist Wey Go Shock You
Na here the real bombshell drop o. Denrele open up say him experience sexual harassment well for the industry . The kain thing wey fit make person vex tire.
“Dem dey do me somehow,” him confess, as e dey yarn how bad people been dey think say because e different, e go weak.
“Omo, guy go just dey inside toilet dey mind him business, next thing the person go come dey try touch me anyhow,” him reveal.
From Reject to Respect
Even with all the harassment and discrimination wey him face, Denrele no just survive him also chop the industry scatter am. On top that, him change how Nigerian entertainment dey see people wey dey express themselves.
Today, young creatives dey hail am say na him be the original person wey make am okay to dey different, to shine well well, to reject all those boring boxes wey society dey put people inside.
