Yanga FM 89.9

Presented by Suo, MC Advice

Yanga Sports

Yanga Sports

Yanga Sports by Presented by Suo, MC Advice


Info and episodes

Denrele Yarn How Goldie Spirit Vex For Mortuary

Written by on February 2, 2026

How Goldie’s Angry Spirit Cause Mortuary Wahala -Denrele Edun 

Icon Denrele Edun  don enter Yanga FM studio come drop bombshell wey dey shake Lagos pass nepa bill. E come open mouth  say na him use hand dress him late bestie, Goldie Harvey, for mortuary and the thing wey happen that morning go make your body dey do you one kain.

Early Morning Wahala Wey Start 6AM Sharp

 Denrele talk say  the thing turn horror film sharp sharp when e dey prepare Goldie body. Na 6 o’clock for morning, everywhere never even bright well well. Him  dey there wan dress him  late friend for the last time. Naso as him see her  face she dey vex,  him sef fear .

“The vibe no just correct from beginning, her face hard she no happy  ” Denrele talk am. Light begin dey blink blink like say na Nollywood juju film we dey watch. Then gbam complete darkness swallow everywhere!

Denrele edun

Denrele edun

Denrele talk say e believe say him girl Goldie dey vex well well and she no dey play about am at all. According to am, Goldie spirit come dey show say she vex through all those electrical kasala and scary things wey dey happen.

The Ghost Visit Wey Scatter Ground

Now na here the matter take worse pass. Denrele talk say Goldie no just stop for mortuary drama o. The babe actually appear later for dream , come dey gist am about people wey wrong her when she still dey alive.

No be small thing him yarn o say she  list everybody we don wrong am plus wetin them do her. Denrele  been dey very emotional talk say but him no get anybody for mind sha and as she talk mention all the people .

Paddy Wey Pass Ordinary

Even though the thing scary die, Denrele still dey talk about Goldie with pure love. Their friendship na the type wey make Lagos entertainment people dey wonder always dey match cloth, always dey serve hot looks, always dey kampe together.

“That day scatter my brain, I no go lie,” e confess. “But I still dey remember her. Our bond tight pass anything.”

Whether you believe all this spiritual katakata or not, one thing clear pass crystal: real friendship no dey fade, even when life don end. The fact say Denrele fit yarn this kain personal, paranormal experience show say their connection deep well well.

 


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist