Yanga FM 89.9

Compound Wahala

Compound Wahala

Compound Wahala by Presented by Rugged Pastor & BabyLawyer


Info and episodes

Forget Your Faves , SYN Don Land

Written by on February 20, 2026

SYN: The Ijebu Princess Wey Don Turn Her Pain To Pure Afrobeats Fire

Afrobeats newcomer SYN  wey dem call Sweet Yet Nuclear in full  just finish sit-down yarn with Yanga FM, and abeg, she dey come with one mad force . The rising star pour raw truth, cultural pride, and serious career gist all in one interview.

From Rebrand To Full Reinvention

SYN open up about how she do full musical rebrand, and Na the best decision she ever make. She describe the whole process like she dey shed old skin to show the real artist wey don dey wait inside her. The new direction sharp, bold, and e carry her vibe fully.

And since we dey talk about her vibe  this babe na Ijebu through and through. She born and grow for Ogun State, she sabi her local dialect very well, and she no dey hide am inside studio grammar. She dey actively pour Ijebu language inside her music, make her sound unique and rooted but still dey touch global ears. No fear, no filter na pure culture full volume.

SYN -sweet yet nuclear

SYN -sweet yet nuclear

The Healing Wey Nobody Dey Talk About

E reach the part wey e get weight. Host Jaycee, wey dey always keep things real, ask SYN about the way rape cases dey rise for society these days. The atmosphere change small  because SYN no dodge the question at all.

She confirm say e happen to her. During her university days, she experience sexual assault. She no go deep into details  and she no need to  but she talk am straight say  e dey painful. But wetin she do after that? Na there her story turn from pain to power. She find Afro Queens.

Queens Dey Save Queens

The day SYN join Afro Queens collective na the day her life change direction. The sisterhood give her focus when everything scatter, give her boost when she dey run on empty, and most importantly  dem give her solace. Real, genuine, women-dey-hold-women kind of solace. Her eyes light up when she dey talk about them, and e show well well.

Sometimes healing no come only from therapy. Sometimes e come from a circle of women wey see you, hype you, and refuse make you small yourself.

Tagged as

Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Continue reading

Current track

Title

Artist