Cruise With Joe: Trust Nobody? Nah. Trust Better.
Written by YangaEditor1 on April 3, 2026
“I No Fear Betrayal because it fit come from person you love” -CruisewithJoe
Joe come yarn with Jaycee and Bybisasa for What’s Up Naija e open mouth, open chest, still tell us everything wey don happen. Joseph Obasi, wey people dey call cruisewithJoe , na the kind person wey you go look and know say this one don see things. Him dey known for him better owerri accent and how him dey push igbo cuture on social media well well. Him walk into that studio like man wey don chop betrayal for breakfast before and still find better food after. E come with full gist from business, content creation, wahala and all the lessons wey pain teach am.
Owerri Restaurant staff Palava
Joe get him business for Owerri Josephs Pot. Mad Restaurant correct location, everything set. Then one morning, e wake up and every single worker don write resignation letter. Same day same time. Nobody send am message beforehand them still no call. Just pure scatter. If that one no wound you, you never start anything serious for this Nigeria.
Friendship wey jam Agbako
Now here na where the gist go deep. The person wey help Joe recruit all those workers na him friend o naso him turn around, offer them better package, and carry them go. The same person wey bring them, come collect them back. No movie fit write this one better. This na real Naija story.
E No Break — E Bend, Then Stand Straighter
Joe tell Jaycee and Bybisasa say e no fall down finish. E sit down with the pain, look am for eye, then use am. That betrayal na the thing wey reset him thinking about who to carry along for business. No more loose arrangements. No more assumption say because una be friends, loyalty dey automatic.
“Na him make me stronger,” Joe yarn and e no sound like motivational caption for Instagram. E sound like somebody wey don calculate the cost of trust and know the real price now.
Him Dream Team Wey Him Build Himself
The version of Joe wey dey operate today get team wey e build with him own hands, him own terms, him own eye. Not connections wey somebody lend am. Not loyalty wey get expiry date. That restaurant issue teach am how to select people. The friend betrayal teach am what to look for. Now him team na the people wey actually choose to dey there. Plus business de bloom .
The Real Gist Wey People No Dey Talk
Joe no hide the rough parts for that interview. E talk about how e feel to dey shout into a big room and people dey turn around . Plus talk about money decisions wey look wrong from outside but make sense inside. Come talk about the difference between people wey dey support you and people wey just dey watch make you fall first.
And that one na the honest part wey most people skip when them dey tell success story.
