Yanga FM 89.9

yanga drive

Cruise Express

Cruise Express

Cruise Express


Info and episodes

Enioluwa: “Una No Understand My Job”

Written by on April 21, 2026

Enioluwa clears air on celebrity friendship and social media  

Enioluwa wey be intellectual  social media influencer and actor don dey in some kind yarns for socials and omo we no know if it clear at all . Social media people don yarn plenty things about Enioluwa recently. Them say him and Kate Henshaw don fall out. Them say him sideline Hilda Baci, the same Hilda wey hold Guinness World Record. Iyabo Ojo and Pricy sef enter the gist. According to Twitter and Instagram detectives, Enioluwa don quietly retire all him friendships without telling anybody. E come sit for chair, hear all the allegations, and calm down reply like man wey know him mind.

 Him Tell Them the Truth Wey Them No Want Hear

Enioluwa look Jaycee straight and yarn say all these people wey dey form analysts no understand one simple thing social media na work. Na job. The same way a banker no bring every client go him birthday party, na the same way him no go post every friend every week. Strategy dey involved. Feelings and posting schedule no be the same department. If him no tag you four times this month, e no mean say una don beef. E fit just mean say the content no call for am.

Enioluwa

Enioluwa on friendships and social media

But the Hilda Baci Chapter? Chai.

This one sweet pass. Enioluwa reveal say the exact day him and Hilda dey trend for “beef,” him was physically with her. Same room. Same space. Him see the tweets, show her, and both of them just dey laugh. The internet don finish write the script, cast the actors, and decide who villain be  meanwhile the two main characters dey chop together somewhere dey monitor the madness.

No bad blood or drama. Just people wey dey online too much.

“Social Media Na My Job” Quote of the Year, Abeg

This point wey him make no be small thing. When content creation na your source of income, every post na decision. Who you tag, who you feature, who you carry for your grid na strategy, not diary entry. People dey use posting frequency to measure friendship like say Instagram analytics dey reflect real life.Him build real friendships wey exist offline, and those ones no need public performance to survive.

Enioluwa waka comot Yanga Studio with everything intact  reputation, friendships, and the calm energy of a man wey know say him no owe the internet explanation, but still gave one anyway.

The yarns will continue if you stay locked in wth us .


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist