Yanga FM 89.9

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija


Info and episodes

“Wetin We Gain” na for Victor AD Alone

Written by on May 19, 2026

Victor AD  — “Wetin We Gain” No Go Get Remix, Even If Jesus Ask Am

Some artists dey chase features Victor AD dey chase legacy  And the difference dey very clear. The buzzing artiste enter Yanga FM go gist about him breakout single Wetin We Gain and wetin come out from that interview go make you respect the guy different different.

From Ghana to Lagos – The Journey Wey Nobody See Coming

Victor AD no just wake up one morning blow for Nigeria. The thing start gradual. Wetin We Gain first catch fire for Ghana, where the song build am serious fanbase before anybody for Lagos even raise eyebrow.

Then Lagos smell am  And una know how Lagos be, when that city lock onto you, everywhere go follow. The song cross border, the streams climb, and suddenly big names for the industry start dey find him number for remix. Not one person but everybody.

Vitor AD Yanga FM

Victor AD for Yanga fm

“Every Big Artist Wey You Fit Think Of Don Reach Out”  Still Say No

This na where Victor AD show say him get backbone wey cast iron jealous. Him confirm am himself  virtually every top artiste wey dey your playlist don slide into him DM for remix feature on Wetin We Gain. Your fave plus Your fave’s fave. The kind names wey go make any upcoming artist faint with happiness. Him answer? One clean, unbothered NO. No vex, no long story  just straight decision from a man wey know wetin him want. Him look big opportunity for face and tell am “e don do.”

The 100-Year Plan Wey Dey Make Sense Scatter

So why him turn down features wey fit change him career? Victor AD explain am simple simple. Him always know say him go blow. That confidence no be pride  na calculation. From the very beginning, him don already decide say Wetin We Gain no go ever get remix, no matter who come, no matter how the bag fat. Him reason dey very solid which be, him want the song to be evergreen. The kind record wey dem go play for party for year 2124 and everybody go still know say na him make am  no confusion, no “which version be this one?”

One version. Him version. Till forever.

The Bigger Picture Wey Many People No Dey See

For one industry where remix and features don become standard formula for blowing, Victor AD dey play completely different chess. Him no dey build for next year  him dey build for next century. And that kind thinking dey rare, especially for artiste wey still dey find him full ground for Lagos.

Wetin We Gain no be just hit song e be statement. And Victor AD don make am clear say that statement go remain exactly as e be .

Tagged as

Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist