Yanga FM 89.9

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija


Info and episodes

Praiz: My Catalogue, My Sound, My Rules

Written by on February 23, 2026

Praiz Break Silence on  X3M Wahala, Depression & How Music Save am From Himself

The veteran Afrobeats star sit down and serve some of the most honest gist wey this industry don hear in a long time. From record label wahala to mental health struggle, this interview carry serious weight.

The X3M Matter wey heavy

 Praiz and him former record label X3M don have their issues  and the internet don already hear the story. Naso as  Yanga FM press him about am, Praiz keep things calm and measured like a true OG.

He no pour plenty grammar. He just say one thing wey be give him him full catalogue and everybody fit move on in peace. No long story, no back and forth dragging. Just one man wey know wetin belong to him and want am back simple simple. The maturity wey he show for that response alone deserve standing ovation.

He no go deep into the details, but him message land clear  . Him don tire to dey ask for wetin rightfully belong to am, and he no go stop until e reach him hand.

Praiz and the Cruise express Gang

Praiz and the Cruise express Gang

Depression Nearly Enter But Music No Let Am Go

Now na here the interview take a different turn entirely. Our guy ,open up about the time wey he comot from music and the reason behind am go deeper than wetin plenty people know.

Depression nearly wound am finish. The weight of everything plus industry stress, label wahala, personal battles  e all pile up and push am to the edge. Music funny enough, na the same thing wey pull am back come. He simply no fit leave am alone. It save him the same way e nearly break am.

Watered Down? Praiz Laugh That Question!

By the time them ask am say whether him break from music go reduce him relevance, Praiz dismiss the whole thing completely  and with good reason.

He make am clear say he no dey follow trend or ride anybody wave. Even as artists like Johnny Drille and others dey slay with love songs, Praiz dey do something entirely different. Him own lane, him own sound, him own rules. He don dey work on dropping new music  and if him track record mean anything, the jams dey come and e go heavy.

Tagged as

Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist