Yanga FM 89.9

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija


Info and episodes

Illbliss Settle The Label Beef Once For All

Written by on May 27, 2026

Illbliss Don Talk Am: “Artists Dey Lazy and Ungrateful But Labels Dey Steal Too”

The veteran rapper and music executive enter Yanga FM go share him unfiltered take on the growing label versus artist drama wey dey Plague  Nigerian entertainment Industry. Plus him dish out truth like na free jollof rice for owambe. Nobody escape the heat.

The Real Problem — Nobody Read The Contract

Illbliss go straight to the root of the matter. According to him, most of these label disputes no really be about wickedness them dey come from ignorance. Mostly affected bypoor business education, and zero understanding of contracts.

Artists dey sign documents wey them no understand, them go celebrate the advance money, and then act surprised when the fine print show up two years later dey find them for house.  The music industry don always be business first  and too many creatives still dey treat am like say na just hobby and passion.

“My Artists Dey Involved In Everything”

This na where Illbliss separate himself from other executives. As a music executive himself, him make am clear say when him sign him  artistes, them  dey fully involved in every aspect of the business the money, the decisions, the strategy, everything. No blind signings. No surprise deductions. Just full transparency from day one.

Him also reveal say him artists dey bring equity contributions  meaning them dey actively participate in building their own value, no just show up for studio dey wait for cheque like civil servant.

Illbliss Yanga FM interview

ILLBLISS AT YANGA FM

New Age Artists Too Comfortable — Illbliss  Talk Am

And then Illbliss yarn the thing wey pepper everybody. Him note say too many new generation artists dey walk around dangerously relaxed  happy to dey pampered by labels while doing bare minimum in return.

Labels dey feed them, dey coddle them, dey manage their tantrums every day and these same artists still no dey work harder. Him yarn say na serious problem wey nobody wan address publicly.

“But Labels Dey Steal Too — Make We Be Honest”

However and this na the part wey balance everything Illbliss no let labels off the hook either. Him acknowledge plainly say labels dey also steal from their artists, and that artists must always get a say in decisions wey concern their own future. The power imbalance dey real. The exploitation dey real. But so be the ingratitude and short-term memory of artists wey forget who invest in them when them never blow. Two sides, one wahala.

Illbliss serve one rare dish  accountability wey no carry bias. Both sides catch slap, and honestly both sides deserve am. For one industry wey dey drown inside one-sided narrative every day, that kind balanced honesty dey hit different. Very different.

Tagged as

Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist